Tinubu don yan better gist about Nigeria economy matter! 💰🇳🇬
President Bola Ahmed Tinubu don talk say economy don balance small and the revenue target wey dem set for this year, government don knock am since August. 🙌
According to am, Nigeria no dey borrow again because money don dey to run government programme sharp sharp. Baba come still brag say when he enter office, dollar na about ₦1,900 but now e don cool reach ₦1,450. He talk say rate don dey stable and people no need to dey lobby CBN again before dem fit do import and export wahala.
Tinubu drop this talk when him meet with Buhari people (The Buhari Organisation) for Abuja.
Naija people, una see say this economy matter don dey change? Abi na political sweet mouth?
Post a Comment
0Comments